Konfam Mornin Jollof

Background
Konfam mornin jollof

Konfam Morning Jollof (5am – 12pm): Wake up with Daddy Swag and Area Mama for your side. You know say morning no dey smile for Lagos! Na why we dey here to wake you up with correct vibes wey go make your day sweet. Whether you dey rush enter danfo, you dey fight for third mainland traffic, or you just dey try wake pikin for school, Konfam Morning Jollof na your guy!

We go gist you about the traffic mata (so you no go enter one-chance/hold-up), tell you if rain wan fall (make you carry umbrella), yarn you the latest sports gist, and break down all the newspaper headlines wey matter. We no dey do long talk; na straight to the point!

But e no stop there o! We dey talk things wey really affect you: your health, your pikin welfare, your rights as citizen, and how you fit take shine for this hustle city. From community amebo to celebrity gist, we get am all. Morning Jollof na your complete breakfast; music, information, laughter, and vibes to help you start your day well well!

Monday - Friday
  • Music 4:00am – 5:00am
  • The Wake-up Show 5:00 am – 6:00am
  • Traffic Report/Weather Report/Celebration/Today in History 6:00am – 7:00am
  • Wetin Paper Talk 7:00am – 7:45am
  • Sport Yans 7:45am – 8:00am
  • News 8:00am – 8:10am
  • Community Amebo 8:10am – 9:00am

  • Know your right 10:00am – 11:00am
  • Funky Palace 11:00am – 12:00am

HIGHLIGHTS

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app