Sports

977 Results / Page 1 of 109

Background

Sports

Barcelona Come From Back Beat Galatasaray 4-1

Barcelona come back from back to beat Galatasaray 4-1 inside dia UEFA Champions League match wey dem play for Rams Park on Tuesday. Galatasaray first shock di Spanish side for di 28th minute through Aleksey Batrakov, after e finish fine pass from Rafael Leão to give di home team lead. Di Turkish side almost double dia lead for di 36th minute, but VAR chop di goal comot say na offside. […]

todayOctober 14, 2026 10

Sports

Wenger Dey Face Pressure Make E Challenge Infantino

By: Jolayemi Olajide Former Arsenal manager, Arsene Wenger, don face pressure from some pipu wey want make e challenge Gianni Infantino for FIFA presidency as opposition to Infantino leadership dey increase. Wenger, wey be Frenchman, currently dey work as FIFA Chief of Global Football Development, and some pipu don begin see am as possible candidate for di job. But Wenger never talk whether e go contest for di position, even […]

todayOctober 13, 2026 8

Sports

Shakiru Giwa Comot As Inter Lagos Coach

By: Jolayemi olajide Shakiru Giwa don comot as head coach of Inter Lagos for Naija Premier Football League, NPFL. Di Lagos club announce di news for dia X account on Tuesday, October 13, 2026, confirm say Giwa no dey in charge of di team again. Giwa na di first coach wey comot im position dis season, but Inter Lagos no talk wetin make am leave. Di club thank am for […]

todayOctober 13, 2026 6

Sports

Ronaldo Near 1,000 Goals as Im Score 981st Career Goal

Cristiano Ronaldo don score im 981 goal for career as Al-Nassr beat Neftchi Fergana team from Uzbekistan 3-1 for di AFC Champions League Elite match on Monday. Di 41-year-old Portuguese superstar score di second goal for Al-Nassr for di 42nd minute after Angelo Gabriel bin open score for 33rd minute inside Al-Awwal Park stadium for Riyadh. Sadio Mane float one sharp cross from di left, Aiman Yahya use im chest […]

todayOctober 13, 2026 6

Sports

Jay-Jay Okocha Back Mbappe For 2026 Ballon d’Or

Super Eagles legend Jay-Jay Okocha don back Real Madrid star Kylian Mbappe to win di 2026 Ballon d’Or award. Di former PSG playmaker tok dis one during interview with French paper Le Journal du Dimanche, wia fry mouth  say Mbappe goal-scoring record make am stand out pass order top players like Harry Kane and Lamine Yamal. Okocha explain say Mbappe deserve di big prize because e finish as top scorer […]

todayOctober 13, 2026 10

Sports

Kayode Oke Score Goal After 18 Seconds

Kayode Oke, wey dey play for Bendel Insurance, score di quickest goal for dis season NPFL as e put ball for net just 18 seconds after match start against Sporting Lagos for Mobolaji Johnson Arena, Onikan, Lagos. Even though Oke give im team early lead, Bendel Insurance no fit maintain di lead as Sporting Lagos fight back to win di match 2-1. Victor Samuel score di equaliser for Sporting Lagos […]

todayOctober 12, 2026 8

Sports

Boniface Vex Comot Field As Leverkusen Beat Mainz 4-3

By: Mariam Ajayi Nigerian striker, Victor Boniface, once again dey vex wetin nor gud, hin even comot field say coach nor play am for Bayer Leverkusen 4-3 win against Mainz for Bundesliga on Saturday. For di 84th minute, coach Carles Martínez bring in Equi Fernández and Jonas Hofmann, but na so Boniface sit don  bench, dey shine eyes, e nor believe say, hin coachie ignore am again, na so baba […]

todayOctober 12, 2026 7

Sports

Eagles Coach Chelle scarra Say Young Boys to Enter Senior Team

By: Kofoworola Olayinka Super Eagles coachie Eric Chelle don go drop micro soft word dey shake everwia, jigijigi, say the young players wey play 3-3 draw with Russia get doings to play with di senior boys. U sabi say, Di coach use experimental squad wey get nine debutants, including three boys wey just be 19 years old play russia. Chelle explain say after how the boys take fight for Nizhny […]

todayOctober 9, 2026 10

Sports

CAS Table Senegal Appeal Based on AFCON Title Drama

By: Kofoworola Olayinka Court of Arbitration for Sport don start to hear Senegal appeal, dia on side of di story, on how  dem take win  Africa Cup of Nations title, CAF con carry  give Morocco via Gmail. U sabi say dis one  hapun for Lausanne, ten months, after Pape Gueye extra-time goal give Senegal win against di host country. Wetin really play dat, na when di  Teranga Lions players comot […]

todayOctober 9, 2026 8

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds