Konfam Morning Jollof (5am – 12pm): Wake up with Daddy Swag and Area Mama for your side. You know say morning no dey smile for Lagos! Na why we dey here to wake you up with correct vibes wey go make your day sweet. Whether you dey rush enter danfo, you dey fight for third mainland traffic, or you just dey try wake pikin for school, Konfam Morning Jollof na your guy!
We go gist you about the traffic mata (so you no go enter one-chance/hold-up), tell you if rain wan fall (make you carry umbrella), yarn you the latest sports gist, and break down all the newspaper headlines wey matter. We no dey do long talk; na straight to the point!
But e no stop there o! We dey talk things wey really affect you: your health, your pikin welfare, your rights as citizen, and how you fit take shine for this hustle city. From community amebo to celebrity gist, we get am all. Morning Jollof na your complete breakfast; music, information, laughter, and vibes to help you start your day well well!
Monday - Friday
Music 4:00am – 5:00am
The Wake-up Show 5:00 am – 6:00am
Traffic Report/Weather Report/Celebration/Today in History 6:00am – 7:00am
Wetin Paper Talk 7:00am – 7:45am
Sport Yans 7:45am – 8:00am
News Tori 8:00am – 8:10am
Community Amebo 8:10am – 9:00am
Bodi Mata 9:00am – 10:00am / Mama and Pikin (Wednesdays)