Education

14 Results / Page 1 of 2

Background

Education

BUK Say Private Electric Bike Charging Don Stop As Light Money Too Much

By: Esther Daniel Bayero University Kano, BUK, on Tuesday ban charging of private electric motorcycles and other electric vehicles for all campuses because di practice don increase di school electricity bills, as management announce di decision through statement by Director of Public Affairs, Lamara Garba. Di university say for Kano say dem take di action after noticing say private owners dey use school power to charge dia vehicles, wey put […]

todayAugust 5, 2026 8

Education

Ekiti First Lady Say Sexual Harassment for Higher Institutions No Go Pass Just Like Dat

By: Esther Daniel Di Wife of Ekiti State Gofnor, Dr. Olayemi Oyebanji, today for Ado-Ekiti vow say sexual harassment for tertiary institutions no go go unpunished, as she talk during meeting with FUOYE management led by Vice-Chancellor Prof. Joshua Ogunwole, because she wan protect students and stop di crime from happening again. She also announce say she go organise statewide gender summit and visit higher institutions across Ekiti to educate […]

todayAugust 5, 2026 7

Education

Surulere Don Show Love, Free Summer Classes Begin for Students

By: Esther Daniel Education don get fresh boost as Surulere Local Gornment on Monday launch free summer coaching for 1,300 secondary school students at Gbaja Girls High School. Council Chairman Yusuf Sulaiman announce say top students for di programme go receive free JAMB and GCE forms to reward good performance. Di four-week coaching go use screened teachers from 23 schools to keep students busy and away from street crime during […]

todayAugust 4, 2026 4

Education

New JAMB Boss Draw Battle Line, Say Exam Fraud No Go Fly Again

By: Esther Daniel New Joint Admission Matriculation Board, JAMB Registrar Prof. Segun Aina don vow say anybody wey wan spoil di integrity of JAMB through exam malpractice or admission fraud go face di full weight of di law. Aina make di promise on Friday during di official handover ceremony for JAMB headquarters, Bwari, Abuja, saying fairness, trust and transparency go remain di foundation of di board. Di new registrar warn […]

todayJuly 31, 2026 12

Education

FG Reduce Textbook Assessment and Ranking Fee

By: Esther Daniel Federal Goment don reduce money wey publishers and authors go pay to assess and rank textbooks, as dem dey prepare to start di National Textbook Ranking System. NERDC Executive Secretary, Salisu Shehu, tok dis one for statement wey dem release on Wednesday for Abuja, say assessment fee don drop from ₦2,000 to ₦1,500 per page, while ranking fee reduce from ₦1 million to ₦750,000 for each textbook. […]

todayJuly 22, 2026 11

Education

JAMB Release Mop-up Results for 2026 UTME

By : Jolayemi Olajide JAMB don finally release di result for di 2026 UTME mop-up exam wey dem do recently. The board tuk tuk, Fabian Benjamin, naim sorosoke dis update say candidates fit go check dia result now through di normal JAMB portal. Every student wey write the mop-up exam right now got go check dia result sharp-sharp to know wetin dey happen.  

todayJune 16, 2026 13

Education

From Corper To Big Boss: How Professor Segun Aina Take Climb Enter Di Top Seat For JAMB

Di tori of how 39-year-old Professor Segun Aina take become di new Registrar of di Joint Admissions and Matriculation Board (JAMB) normally suppose to be beta ginger for everyone. Na Thursday, May 21st, 2026 wey news break say na new senior man, Prof Aina, go take over for JAMB after Professor Ishaq Oloyede tenure finish on July 31st, 2026, expectation dey very high, nor be lie for reason being dat […]

todayMay 25, 2026 26 7

Education

Viral 394 UTME Result Na Fake – JAMB

Di Joint Admissions and Matriculation Board don come out reject one UTME result wey dey trend for social media, say na fake oh. Dem say di result show one girl from Cross River, Okon Winniefred Sampson, scoring 394 out of 400, Jamb now dey tuk say dat kind result nor dey dia system. According to JAMB spokesman, Fabian Benjamin, di result slip na fake result. Fabian still beg Nigerians make […]

todayApril 27, 2026 21

Education

JAMB Panel Catch 4,251 Finger Blends, 190 AI-Assisted Cheats For 2025 UTME

Joint Admissions and Matriculation Board (JAMB) don receive report from Special Committee on Examination Infractions (SCEI) wey show how technology-based cheating dey spoil Nigeria admission process. For Abuja on Monday, Professor Is-haq Oloyede, chairman of the committee, Dr. Jake Epelle, report to JAMB Registrar, say dem find 4,251 cases of “finger blending” plus 190 cases of AI-assisted impersonation with image morphing during investigation into 2025 UTME. The panel, wey dem […]

todaySeptember 9, 2025 59 7

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds