Blog masonry

Background

Sports

Na Blank Nigerian Stars Fire For Tough Weekend

E no be sweet weekend for many Nigerian ballers across Europe as dem fire blanks for dia various leagues. For Turkey, Victor Osimhen wey just score hat-trick against Ajax for midweek play full 90 minutes for Galatasaray but no fit continue him hot form as di Turkish champions lose 1-0 to Kocaelispor. Him late goal for 83rd minute chop VAR offside wahala. For England, Frank Onyeka no get minutes as Brentford beat Newcastle 3-1, while Chrisantus Uche still dey bench […]

todayNovember 10, 2025 28

Sports

Man City Scatter Liverpool, Dey Close Gap For Arsenal Top Spot

Erling Haaland no even allow early penalty wey e miss break him spirit as e later nod in him 99th Premier League goal before Nico Gonzalez shot wey deflect and one sweet thunder strike from Jeremy Doku confirm say Man City still be Arsenal main wahala for title chase. Liverpool don now lose four of dia last five league matches wey don drop dem go 8th position, eight points behind top. Arsenal own 10-match winning streak don end for dia […]

todayNovember 10, 2025 22

National

“Useless Black African People!” – Nnamdi Kanu Vex For Judge Inside Court

Nnamdi Kanu, wey be di leader of Indigenous People of Biafra (IPOB), don para for court today, November 7, as e face im terrorism trial. Kanu wey dey defend himself refuse to open im defence, instead e burst vex for di judge, talk say di judge no sabi wetin justice mean. “You no know wetin justice mean. You no even get idea of wetin justice be,” Kanu talk. E come add say, “Useless Black African people, una no sabi di […]

todayNovember 7, 2025 77 1

Sports

Morocco Go Host 2025 CAF Awards For November 19

Di Confederation of African Football (CAF) don confirm say di 2025 CAF Awards go shele for Rabat, Morocco on Tuesday, November 19 by 7 p.m. local time (same as Naija time). According to wetin CAF yarn for dia website on Friday, di big ceremony go celebrate Africa best footballers, coaches, clubs and national teams wey don shine for di past year. Naija go show face well-well for di event as plenty of our players don make di shortlist. Victor Osimhen […]

todayNovember 7, 2025 40

National

FEC: Tinubu Government Go Build Houses For Abuja Judges

Di Federal Executive Council (FEC) don approve di construction of official residences for heads of key federal courts and also give go-ahead for major water and infrastructure projects across di Federal Capital Territory (FCT). Di FCT Minister, Nyesom Wike, reveal dis one as e brief State House correspondents after di FEC meeting wey President Bola Tinubu preside over for Presidential Villa, Abuja. Wike talk say di approval include design and construction of houses for di President of Court of Appeal, […]

todayNovember 7, 2025 23 3

National

2026 Hajj: NAHCON Don Complete Hotel And Kitchen Check For Madinah

Di National Hajj Commission of Nigeria (NAHCON) don talk say dem don finish strategic inspection of accommodation and catering facilities for Madinah as part of early preparation for di 2026 Hajj operations. NAHCON yaRn dis one for statement wey Ahmad Muazu, Technical Assistant to di NAHCON Chairman on Media, release. Muazu talk say di inspection exercise happen from November 3 to 5 and na Prof. Abubakar Yagawal, Commissioner wey dey in charge of Planning, Research, Statistics, Information and Library Services […]

todayNovember 7, 2025 27

National

Police Don Nab Two Cameroonians Over Kidnap And Human Trafficking

Di Ogun State Police Command don arrest two Cameroonian nationals wey dem link to one notorious syndicate wey dey lure and kidnap innocent victims under disguise of helping dem process foreign visa. Di Command spokesperson, CSP Omolola Odutola, talk say di arrest happen on Tuesday around 10:30 a.m. after operatives of di Anti-Kidnapping Unit, Eleweran, respond to distress call from one Cameroonian woman wey explain how one of her country people, Donald, deceive her enter Nigeria with promise of getting […]

todayNovember 7, 2025 22 18

National

Police Don Arrest Suspect For Rape And Murder Of Ugochi For Rivers

Di Rivers State Police Command don arrest one suspect wey dem dey link to di rape and murder of one young woman for Oyigbo Local Government Area. LIB report say di woman wey dem identify as Ugochi Success Anosike, allegedly get raped den strangled to death for her room on Tuesday night. One family friend of di deceased, @torty_mercy, raise alarm for social media, dey beg police make dem intervene sharp sharp. Di case don make plenty Nigerians vex for […]

todayNovember 7, 2025 43

National

Police Don Start Search For Missing 38-Year-Old FRSC Officer And Im Pikin

Di Ogun State Police Command don start serious search for one 38-year-old female FRSC officer, SRC Lasisi Funmilayo Oluwamayokun, and her pikin, Sewa Lasisi, wey don miss since November 2, 2025. Di FRSC woman and her daughter reportedly commot from dia house for Obasanjo Hilltop Estate, Oke-Mosan, Abeokuta, but dem no return. Family and colleagues don try reach dem by phone and other means but e no work. Di matter don reach Kemta Divisional Police Headquarters, where another FRSC officer […]

todayNovember 7, 2025 38

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds