National

1288 Results / Page 127 of 144

Background

National

Herdsman And 36 Cows Kpai For Plateau

One herdsman, Abubakar Alhaji Woda, don die after unknown gunmen ambush am for Ndinn village, Fan District, Barkin Ladi LGA, Plateau State. Di attack happen on Monday evening as Abubakar dey graze him cattle. Dem shoot am dead and fire gun for him cows too, kill 36 for di spot. Witness dem talk say di attack no get reason and people for di area dey fear as insecurity dey increase […]

todayOctober 9, 2025 19

National

Police Nab Two Guys Wey Dey Feed Bandits Inside Kogi Bush

Security operatives for Yagba West Local Government Area, Kogi State, don catch two men wey dem accuse say dem dey supply food and logistics to bandits wey dey hide for forest. Di suspects na Abayo David and David Bori from Itedo-Ijowa, Isanlu inside Yagba East LGA. Dem nab dem early morning around 4:00 a.m. on Wednesday, October 8, 2025, during patrol by Yagba West Hunters and Vigilante Group. Dem find […]

todayOctober 9, 2025 31

National

Truck Crush Man Die After E Drop Him Pikin For School For Ondo

One man don die gbalaga after one truck crush am for Oda Road, Akure, Ondo State. Di tragic gbege happen early morning on Wednesday, October 8, 2025, as di man dey go back house after e drop him children for school. Tori wey land talk say di truck wey dey speed anyhow lost control, jam di man motorcycle and kill am straight for di spot. One eyewitness wey follow talk […]

todayOctober 9, 2025 22

National

My Resignation No Mean Say I Guilty – Uche Nnaji

Former Minister of Innovation, Science and Technology, Uche Nnaji, talk say e no resign because e do bad thing. E talk say e step down na to protect im name and make sure government reputation no spoil. Nnaji resign on Tuesday, October 7, after gbege burst about im school certificate. University of Nigeria, Nsukka (UNN) talk say dem no give Nnaji any degree certificate because e no finish im school. […]

todayOctober 9, 2025 26

National

FG Dey Beg ASUU Make Dem Comot Di Strike Plan Now.

Federal Government don beg ASUU make dem comot dia planned strike as government dey try settle all di wahala wey ASUU don raise. Minister of Education, Tunji Alausa, talk for Abuja say government don dey work on di union demands and talks between both sides don dey move well. Di Mahmud Yayale Ahmed Federal Government Tertiary Institutions Expanded Negotiation Committee don re-start to make talks quick with all academic and […]

todayOctober 9, 2025 26

National

Tinted Permit Wahala Don Cool Down – FCT Police Tok-Tok Pesin Yarn

Di Nigeria Police Force don talk say dem don suspend di enforcement of tinted glass permit for motor dem, sake of court order wey stop di whole exercise. SP Josephine Adeh, wey be di tok-tok pesin for Federal Capital Territory (FCT) Police Command, yarn dis one for AIT on Wednesday, October 8. She confirm say di mata na afta dem receive official court order. “Information wey reach me from PRO […]

todayOctober 9, 2025 24

National

Gas Scarcity: Price Na Scam, Middlemen Dey Chop Nigerians – NALPGAM

Nigerian Association of Liquefied Petroleum Gas Marketers (NALPGAM) don raise alarm over how cooking gas price don dey jaga-jaga for everywhere for country, say di price wey dey now na fake. National President, Oladapo Olatunbosun yarn dis one for Channels TV The Morning Brief on Wednesday. E talk say di wahala na because PENGASSAN and Dangote Refinery fight, wey cause strike. Di strike make price waka comot from about ₦1,700 […]

todayOctober 8, 2025 27

National

Minister For Innovation, Science And Technology Don Run Comot As Dem Catch Am For Certificate Waka Gbege

Minister for Innovation, Science and Technology, Uche Nnaji, don resign as certificate wahala full ground. Bayo Onanuga, Presidential spokesman, confirm say Nnaji don step down on di night of  October 7. Reports talk say University of Nigeria, Nsukka (UNN) deny say dem ever give Nnaji Bachelor of Science degree certificate because e no finish school. UNN Vice-Chancellor, Simon U. Ortuanya talk say Nnaji come school for 1981 but e no […]

todayOctober 8, 2025 21

National

Yakubu Don Hand Over To Agbamuche As INEC Acting Chairman

Professor Mahmood Yakubu don hand over to May Agbamuche as Acting National Chairman of Independent National Electoral Commission (INEC). Agbamuche na di oldest serving National Commissioner for di electoral body. Yakubu announce dis one Tuesday during ongoing meeting with Resident Electoral Commissioners for INEC headquarters Abuja. E ask di commissioners and directors make dem support Agbamuche till new permanent chairman come. Yakubu dey leave office after completing im two-term 10 […]

todayOctober 8, 2025 20

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app