Konfam Evening Totori

Background
Konfam Evening Totori

KonfamEvening Totori (4pm – 9pm): With Igwe the Otwetwe 1 and Lolo the Big OG.

Evening don land and you don dey head back home? Or you still dey office dey do overtime, abi you dey close shop for market? Konfam Evening Totori dey here to keep you company as the sun dey go down!

This na the time wey we dey mix everything together like correct jollof rice:-information, entertainment, family matter, and plenty vibes! We go yarn you sports tori, give you newspaper update for those wey no get time read am, and we go shock you with things wey you never know before. You fit dey listen make you even win something because giveaway plenty for Konfam FM.

We go dey discuss issues wey dey affect your home and community, some kind stories and things wey you go hear wey go shock you, proverbs wey our papa pass down and their meaning. So whether you dey inside traffic jam or you don reach house dey relax, we dey make sure say boredom no go near you at all!

Konfam Evening Totori na your companion from office/market to house; we dey keep the vibe alive!

Monday - Thursday
  • Konfam Quest 4:00pm – 5:30pm
  • Wetin Pale Talk 5:30pm – 6:30pm
  • Sports Yarns 6:30pm – 7:00pm
  • News 7:00pm – 7:10pm
  • E Shock you 7:10pm – 7:45pm
  • Family Meeting 7:45pm – 8:45pm
  • Konfam Chop Word 8:45pm – 9:00pm
  • Konfam Quest 4:00pm – 5:30pm
  • Konfam Call 5:30pm – 6:30pm
  • Sports Yarns 6:30pm – 7:00pm
  • News 7:00pm – 7:10pm
  • E Shock you 7:10pm – 7:45pm
  • Family Meeting 7:45pm – 8:45pm
  • Konfam Top 5 Countdown 8:45pm – 9:00pm

HIGHLIGHTS

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app