Night Mata

Background
Night Mata

Night Mata (9pm – 12am): Shhhh… pikin don sleep, the neighbors don close their door, and now na time for big people talk! Una welcome to Night Mata with Madam Toku Toku; where we dey keep am 100% and no topic dey off limits!

You get family wahala wey dey heavy for your heart? Your in-laws dey stress you? You and your partner dey misunderstand each other? Bring am come, we go yarn am finish! From husband-and-wife matter to pikin upbringing, we dey address every family gbege wey dey disturb your peace.

Whether you dey find love, you dey inside love, or love don wound you, we get something for you every night! From intimacy issues to matchmaking serious people wey dey find love, Night Mata dey run am!

And if you get heavy secrets wey you wan pour out? Na still your zone! Come confess wetin dey your mind without fear—whether na relationship matter, sexual confession, or guilt wey dey kill you softly. We go listen, we go counsel you, and we go help you find peace.

 

Night Mata na where healing dey happen when everywhere don quiet. Tune in, pour out your mind, and sleep well.

Monday - Thursday
  • House Palava/How Una See Am? 9:00pm – 10:00pm
  • Heart 2 Heart (Monday – Love me Jeje, Tuesday – Thoughtful Tuesday, Wednesday – Wet Wednesday, Thursday – Konfam Connect) 10:00pm – 11:00pm
  • Confession Night (Monday – Flip the Table, Tuesday – Vent Tuesday, Wednesday – Sexcapades, Thursday – Confession Night) 10:00pm – 11:00pm

HIGHLIGHTS

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app