Abia Dey Jolly As Tinubu Commission Port Harcourt Road Wey Dem Rebuild
Aba, di commercial city, turn big carnival ground wen President Bola Ahmed Tinubu commission di 6.7km Port Harcourt Road wey Julius Berger Nigeria PLC rebuild. Di place full with better singing and dancing, masquerade display, DJs dey drop better sound. Women and youths no carry last, dem rush come dey celebrate di project like say na redemption. President Tinubu no show face but send Minister of Works, Engr. Dave Umahi. […]