ADC Accuse FG Say Dem Dey Manipulate Food Price For Politics
Di African Democratic Congress (ADC) don blast President Bola Tinubu government, accuse dem say dem dey lie give Nigerians about food matter. For statement wey dia spokesman, Bolaji Abdullahi, release, di party talk say Tinubu administration dey deceive people with fake gist say food don cheap and local production don increase. According to ADC, wetin di government dey do na to “manipulate food price and use hunger take do politics.” […]