Osimhen And Galatasaray To Show Muscle For UCL Survival
By: Rilwan Agbomeji Super eagles Striker, Victor Osimhen and im club Galatasaray dey at risk to drop out from UEFA Champions League today, afta collobing just 10 points and sitting 17th for di champions league table. Galatasaray dey fear say dem fit comot from Europe top competition if dem nor avoid heavy loss. Dem go play final group match for Manchester City wey sef need win to enter top eight.