Senator Natasha Cybercrime Case Jam Gbege, Dem Push Am Go Oct 20
Trial wey dey go against suspended Kogi Central Senator, Natasha Akpoti-Uduaghan, for alleged cybercrime before Justice Mohammed Umar for Federal High Court, Abuja, jam gbege after the defendant raise objection. Akpoti-Uduaghan don face court since June 30 on six-count charge wey Director of Public Prosecution of Federation (DPPF), Mohammed Abubakar, file against her. Dem grant her bail, after dat Justice Mohammed Umar adjourn case till September 22 make trial begin. […]