Akpabio Explain Say Senate No Stop Electronic Election Result Transmission
By: Esther Ayoola Senate President Godswill Akpabio, say Senate no remove electronic transmission of election results for di amendment wey dem dey work on. E tuk say lawmakers just wan discuss if e suppose dey mandatory make results dey show for real-time. Akpabio defend di amendment, say, badbelle pipo just dey rush judgement based on part of di legislative work.