Gunmen Kpai Five As Dem Open Fire For Plateau Village Party
By: Esther Ayoola Five pipo naim kpai afta gunmen open fire for Gwan-Ajang village for Foron District, Barkin Ladi LGA of Plateau State on Sunday night. According to police tuk, tuk person, Alfred Alabo, di attack happen while villagers gather for one event. Di seniorman police explain how dem take quickly send officers from Gindiri Division go di area and dat now dem dey do investigation.