Malami Don Point Hand Give EFCC Say Dem Dey Play Wayo
By: Esther Ayoola Former AGF and Justice Minister, Abubakar Malami, don raise dust on Monday as e demand make EFCC oga rescue himself from any investigation wey concern am. Through im spokesman, Muhammad Doka, Malami allege say EFCC dey run di probe with bias, personal beef and political witch-hunt because e just comot go ADC party. Di former minister accuse anti-graft body of illegal detention, media wahala and breaking due […]