Keyamo Shake NCAA Oga Dem Sake Of Corruption Wahala
By: Rilwan Agbomeji Minister of Aviation, Festus Keyamo, don reshuffle some big oga dem for Nigeria Civil Aviation Authority because people dey talk say corruption dey happen. Dem say di change fit get connection with poor work and weak monitoring for di Directorate of Airworthiness Standards. Meanwhile, Nigeria Safety Investigation Board release report say two different aircraft get serious incident for Kano and Owerri for December. One Hawker aircraft crash-land […]