Ondo Police Gbab Notorious Cult Leader Bella For Owo
By: Esther Ayoola Ondo State Police Command don arrest one suspected cult leader wey dem dey call Akinwale Tomiwa for Owo, Owo Local Government Area. Police tuk, tuk, DSP Abayomi Jimoh, say di arrest hapun on Sunday afta Special Anti-Cultism Squad for Akure get correct intelligence. Di Police say Tomiwa, wey pipo sabi as Bella, dey involved for killing of one Rufus Giwa Polytechnic student, Ojo Peter and other crimes. […]