TEAM NIGERIA

5 Results / Page 1 of 1

Background

Sports

Quadri Aruna To Lead Naija Table Tennis Squad For Libya Africa Cup

By: Esther Ayoola Five-time champion Quadri Aruna say, ni go lead Team Nigeria for di 2025 ITTF Africa Cup wey go shelle for Libya from Saturday, February 7 reach Monday, February 9. Na first time Libya dey host big table tennis tournament, like dis one. Aruna go play men’s singles with Omotayo Olajide, while Fatimo Bello and Ajoke Ojomu go represent Nigeria for women’s singles. Dem dey hope to reclaim […]

todayFebruary 6, 2026 5

Sports

Naija Athletes To Jim Bodi For Scotland Four Weeks Before Commonwealth Games

By: Esther Ayoola Naija athletes go camp for Scotland for four-weeks todo jim jim di body before 2026 Commonwealth Games For Glasgow. National Sports Commission Director-General, Bukola Olopade, ni dey konfamate dis infomate, say dem pick Aberdeen to make things easy and reduce wahala of travel. E say early arrival go hellep athletes adjust well and sabi how di conditions go be once di competition start. Team Naija go reach […]

todayJanuary 26, 2026 9 9

Sports

Amusan Snatch Silver For 100m Hurdles For Tokyo World Championships

Na Nigeria own world record breaker Tobi Amusan snatch silver for women 100m hurdles at Tokyo World Championships this Monday. Amusan run 12.29 seconds, just behind Switzerland’s Ditaji Kambundji wey shock everybody with national record of 12.24 seconds for gold. American Grace Stark knack bronze with 12.34 seconds, while Olympic champ Masai Russell finish fourth with 12.44 seconds. US athlete Masai Russell, Nigeria’s Tobi Amusan, US athlete Grace Stark, Jamaica’s […]

todaySeptember 16, 2025 19

Sports

Ajayi Carry 6th As Jamaica Man Seville Run Sharpest For 100 Metres

Team Nigeria hope to win medal for 100m for the 20th World Athletics Championships wey happen for Tokyo, Japan, scatter yesterday as Keyinsola Ajayi come finish six for the race wey Jamaica man Oblique Seville run sharp pass everybody. Seville run like say e get fire for body, e do Personal Best time of 9.77 seconds (+0.3) to carry gold medal come, and put im name for Jamaica sprinting history. […]

todaySeptember 15, 2025 26

Sports

World Championships: Team Nigeria Don Take Off For Tokyo Today

Nigeria contingent wey get athletes and officials go comot country today (Tuesday) for 2025 World Athletics Championships wey dey Tokyo, Japan, wey go start Saturday, September 13. Some US-based athletes don already land Tokyo, but the group wey dey comot today na mix of athletes and officials. Last week, Athletics Federation of Nigeria show 15-athlete list wey get seven women and eight men. Tobi Amusan, wey hold world record for […]

todaySeptember 9, 2025 40

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app