Sports

2025 U-17 WWC: Olowookere Dey Vex Say Flamingos Miss Plenty Chances For Loss To Canada

todayOctober 20, 2025 3

Background
share close

Flamingos head coach, Bankole Olowookere don blame plenty missed chances as di reason why him girls chop heavy 4-1 loss from Canada for dia first match for di 2025 FIFA U-17 Women’s World Cup. Di Nigerian girls start dia campaign with wahala as Canada score early for 2nd minute through Gabriela Istocki. But Queen Joseph balance am later for 30th minute as she pounce on loose ball take equalise. Flamingos press but Canada goalkeeper, Khadijah Cisse, deny dem with sharp saves.

Na those missed chances later haunt di girls as Canada knock in three more goals late for second half through Julia Amireh wey score two, and Melisa Kekic. Olowookere yan say even though di loss pain, dem go move on and focus on di next game. “This was a huge game. Sometimes mistakes happen. We had our chances at the first half. We didn’t take advantage of them and we paid dearly for it,” na wetin Olowookere yarn as FIFA.com quote am. E still talk say di team go go back, watch tape, learn lessons and bounce back. Flamingos go face France next for Rabat on Wednesday.

 

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app