News-edi 2

1801 Results / Page 1 of 201

Background

Sports

Fury and Joshua Fix December 12 For Dia Heavyweight Fight

By: Mariam Ajayi Boxing fans don rush go buy off all di hotel rooms inside Cardiff town ahead of di December 12 fight between Anthony Joshua and Tyson Fury. Papa Emeka, and Mummy Ife wey dey plan carry  side chick and cock  go for dirty December, abort plans, abort plans, Cardif don cast like dis. Di Welsh capital  don bring body out say dem go use dia  Principality Stadium host […]

todaySeptember 18, 2026

obodo oyinbo

Trump Boil Hot, Vow To Turn Iran Back To Factory Setting

By: Mariam Ajayi US Presido, Donald Trump don enter high gear dey brag say e mind dey tell am to totally wipe out e Iran enemies, warning say anything fit happen as e head dey boil like hot stew. Wetin hapun be say,  aproko dey fly dat some Iran army boys go  scarra one big cargo ship for Strait of Hormuz water, while UN investigative panel come open tuk, say […]

todaySeptember 18, 2026 1

OBODO NAIJA

Sowore Vow Commot First Lady For Office If E Win 2027 Election

By: Mariam Ajayi African Action Congress presidential candidate Omoyele Sowore don drop am say if hin win di  2027 presidential election, say hin go cancel di office of di first lady, dis one nor be sherekanbia. Sowore drop dis hot statement TV sit down tok  on Thursday, say im nor dey for dat one wey im wife go con sit dwon for front of motor, begin do like small nokia […]

todaySeptember 18, 2026 2

Lagos

Lagos Lawyers Back Gorment Waka To Stop Street Begiebegie

By: Mariam Ajayi Lagos lawyer association don back di new law wey gornment wan use clear beggars and agbero boys commot for road. Lagos NBA Chairmo, Oga Uchenna Akingbade, naim sorosoke dis mata  inside one public hearing ontop di 2026 Street Urchins Prohibition Bill. Di lawyer boss cry out say di wahala long  pass  Lekki-Epe expressway, as e beg gornment make dem sharp-sharp declare total emergency for all those area […]

todaySeptember 18, 2026 1

Sports

Falconets Uzoma, Kareem Ginger For England Clash

By: Ayobami Dada Falconets players Christiana Uzoma and Ramotalahi Kareem dey in good mood as dem prepare to face England Young Lionesses for di Round of 16. Moses Aduku team go battle England for Bielsko-Biala Stadium on Thursday, today, as dem fight for place for di quarter-finals. Falconets captain Uzoma say di team don fire up and ready for di important match. Kareem play big role as Nigeria beat New […]

todaySeptember 17, 2026 6

obodo oyinbo

US Gbab 56-Year-Old Nigerian Woman Over Illegal Voting

By: Ayobami Dada Di United States of America don arrest one 56-year-old Nigerian woman, Gladys Adaeze Okafor, for allegedly claiming to be American citizen before she vote for election. Na di US Department of Justice announce dis case on Wednesday, September 16, 2026. Assistant US Attorney Julissa Walsh of di Major Crimes Unit dey handle di prosecution. Okafor dey expected to show face before federal court for Boston, and if […]

todaySeptember 17, 2026 5

Politics

Shettima Tell Kwara Politicians Make Dem Settle Election Mata

By: Ayobami Dada Vice Presido, Kashim Shettima say Presido Bola Tinubu don show political maturity by forgiving northern govos wey no support im presidential ambition for di 2023 election. Shettima tok dis one on Wednesday for Ilorin during di turbanning of Kwara State Governor, AbdulRahman AbdulRazaq, as Sardauna of Ilorin Emirate by di Emir of Ilorin, Alhaji Ibrahim Sulu-Gambari. As 2027 election dey come closer, Shettima tell politicians make dem […]

todaySeptember 17, 2026 6

Lagos

Lagos Taskforce Vow To Deal With Road Blockers, Okada

By: Ayobami Dada Lagos Taskforce don warn road users and anybody wey dey block public roads or do things wey fit put people life for danger say enforcement go increase for di state. Di Taskforce Chairman, CSP Adetayo Akerele, talk dis one on Wednesday for di agency 2026 Stakeholders’ Engagement Programme wey hold for Safety Arena, Bolade-Oshodi, Lagos. Akerele say dem go enforce di law against okada riders wey dey […]

todaySeptember 17, 2026 4

Obodo Niger

Tinubu Order 95% NIN Registration By December 2026

By: Ayobami Dada Presido Bola Tinubu don order make Naija reach 95 per cent NIN enrolment coverage by December 2026, as hin tok am on the 8th National Identity Day celebration for Abuja on Wednesday. Tinubu, wey hin Chief of Staff Femi Gbajabiamila represent, say Federal Government dey build digital infrastructure wey go help use Naija identity system drive economic growth. Hin say gofment wan make secure national ID useful […]

todaySeptember 17, 2026 5

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds