Sports

2026 WCQ: Osimhen Na Di Best Striker For Di World, We Ready For Playoffs — Chelle

todayOctober 15, 2025 5

Background
share close

Super Eagles head coach Éric Chelle don talk say Victor Osimhen na di best striker for di world after di Galatasaray star carry di team waka win Benin Republic for Uyo on Tuesday. Nigeria knack 4-0 for di 2026 FIFA World Cup qualifying matchday 10. Osimhen score two goals for di first half and still add another one after di break. Chelle come talk say im players be champions, say dem deserve di win even though e no easy with new coach and new style, but di players adapt quick quick.

Now, Super Eagles go shift eye to di playoffs wey dem go face Cameroon, Gabon and Democratic Republic of Congo. Chelle talk say e dey ready for di challenge and e proud of everybody, including di fans wey push dem. E yan say “Now we go Morocco, e go hard but na di beginning. I proud of everybody.” Di Malian coach sure say better tins dey come for Nigeria football.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app