Sports

£800,000 Don Vanish From Bissouma Account

todayNovember 7, 2025 7

Background
share close

Premier League star, Yves Bissouma, don lose over £800,000 after dem done thief am money from im VIP Coutts bank account. Di £30million Spurs midfielder money wahala start from September 2022 reach June 2024. Maurice Gomes, 31, bin first arrested after Bissouma report am over one year ago. Metropolitan police confirm say Gomes face two counts of fraud by false representation since October, wey fit carry 10 years jail for each offence. Court record wey The Sun get talk say Gomes don “dishonestly” transfer Bissouma cash enter im own account without Bissouma knowledge or consent.

Prosecutor claim say Gomes move di illicit bank transfer totalling £834,334.40 “to make personal gain.” Nobody sabi how di man relate with Bissouma or how e take access di account. Gomes dey live for £1.4million six-bedroom house for Enfield, North London, and e go appear for Highbury Corner magistrates’ court today. Bissouma, 29, wey dey bank with Coutts, and wey dey earn £50,000-a-week for Spurs, fit need give evidence if di case reach trial. Di Mali international join Spurs from Brighton in 2022.

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app