News-edi 1

2592 Results / Page 1 of 288

Background

obodo oyinbo

Israel Giv Greece 22 Items Wey Dem Thief From Dem

Israel don return 22 ancient artifacts wey dem steal from Greece, as di two country dey use di cultural exchange take make dia relationship strong well-well. Di Israel Antiquities Authority Theft Prevention Unit na dem find di stolen items, even though officials no talk how dem take see dem or how dem take carry am comot from Greece. Greek Minister of Culture, Lina Mendoni, naim receive di ancient objects for […]

todayOctober 14, 2026 4

OBODO NAIJA

Atiku Drag Tinubu Govment As Things Dey For Naija

Former Vice Presido Atiku Abubakar, don scata table again oh drop hin mouth odour, drag wi baba presido,  criticise Presido Bola Tinubu over high cost of living and insecurity wey dey make life hard for Nigerians. E tok dis one for im X page on Wednesday,  say na only wicked leader go pretend like say hin understand suffer. Atiku, wey be ADC presidential candidate, say plenty families nor fit afford […]

todayOctober 14, 2026 5

OBODO NAIJA

Bad Smell Dey Worry Igbokoda Pipu Since Plane Crash

Nine days don pass since Air Force plane crash for Igbokoda, Ondo State, and till now dem never find di plane and 25 pipu wey dey inside. Igbokoda king, Oba Afolabi Odidiomo, say bad odor and fuel wey enter river don dey worry pipu wey dey use di water cook and do house work. E don beg Federal and Ondo State govos make dem do fast find di bodies and […]

todayOctober 14, 2026 7

Lagos

NAFDAC Seize Fake Drinks Wey Worth Over ₦2 billion for Lagos

NAFDAC don uncover over 20 illegal shops wey dem dey use cook fake drinks for Zamfara Plaza, inside Lagos International Trade Fair Complex, Ojo, on Tuesday, October 13, 2026. Di agency say dem gbab pipo wey dey mix fake drinks, change expiry date for old drinks to make dem look like fresh one and keep drinks wey dem ban for sale. NAFDAC say dem gbab two suspects and carry fake […]

todayOctober 14, 2026 6

OBODO NAIJA

APC, APM Dey Drag Each Other On Top Billboard Mata

APC campaign team for Senator Sharafadeen Alli don point finger at supporters of APM Govo candidate, Bimbo Adekanmbi, say na dem damage Alli and im running mate, Soji Adedeji, billboards for different parts of Ibadan on Wednesday. APC say di damage happen for Mokola, Sango, Monatan-Olodo road, Odo-Ona and Toll Gate-Iwo road side of Lagos-Ibadan expressway. But APM fire back, say APC dey lie, just to win Oyo pipu trust. […]

todayOctober 14, 2026 6

OBODO NAIJA

Adeleke Fly Go Abuja For Tinubu 2027 Campaign

Osun State Govo, Ademola Adeleke, don comot for Abuja on Wednesday ahead of inauguration of APC 2027 Presidential Campaign Council, as video show am dey waka with im protocol team go meet private jet wey go carry am. Di inauguration go hold for Banquet Hall of Presidential Villa, Abuja, as dem recently appoint Adeleke as Osun State coordinator for Presido Bola Tinubu 2027 re-election campaign. Di appointment put am among […]

todayOctober 14, 2026 5

Sports

Barcelona Come From Back Beat Galatasaray 4-1

Barcelona come back from back to beat Galatasaray 4-1 inside dia UEFA Champions League match wey dem play for Rams Park on Tuesday. Galatasaray first shock di Spanish side for di 28th minute through Aleksey Batrakov, after e finish fine pass from Rafael Leão to give di home team lead. Di Turkish side almost double dia lead for di 36th minute, but VAR chop di goal comot say na offside. […]

todayOctober 14, 2026 6

obodo oyinbo

UN Press Yarns On How To Return For Peace Eastern Congo

United Nation, don drop micro soft word say peace dey possible for  eastern Democratic Republic of Congo. And na di senior UN oga, Huang Xia dey porporly dis mata give Security Council on Tuesday say US and Qatar peace talks make beta sense. U sabi say y di area wey get plenty mineral dey sufferly wetin nor good  for many years, as Rwanda-backed M23 fighters and Congo army dey gbege […]

todayOctober 14, 2026 6

OBODO NAIJA

Senate Pass Bill Say Na Jail For Any Person Wey Try kpai Imself

Senate don pass bill for second reading wey happun yesterday, dey hold gorund say suicide attempt  na crime against naija law. Na Senator Asuquo Ekpenyong, wey dey represent Cross River South, naim bring  bill to replace jail punishment, with medical care and rehabilitation. Ekpenyong tok say di current law dey make people fear to seek help. Na so Senate presido, Godswill akpabio begin burst laugh, say oga na crime,dat if […]

todayOctober 14, 2026 7

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds