National

Tinubu No Get Plan to Stay Pass 2031 – Presidency Reply El-Rufai

todaySeptember 22, 2025 4

Background
share close

Di Special Adviser on Information and Strategy to President Tinubu, Bayo Onanuga, don reply former Kaduna State Governor Nasir El-Rufai, say di talk say President Tinubu wan remain for power pass im tenure na “baseless and absurd.” El-Rufai make di statement during one visit from former Vice President Atiku Abubakar over di weekend, where e accuse Tinubu government say e dey turn to dictatorship, even compare am to Cameroon President Paul Biya, wey don dey power since 1982. El-Rufai still talk say dis government dey gather all power for centre, and e warn say this kain thing fit scatter Nigeria democracy. “Honestly sir, this thing na shame. The way wey people dey behave now, e show say all those years wey dem dey shout say dem dey fight for democracy and NADECO, all di gra-gra about true federalism, na wash, na fake. Because this Tinubu government dey try carry everything go centre, instead of to share power give lower levels,” El-Rufai talk. “If we no join hand end this Tinubu government by 2027, na big problem we go face. All di signs dey there, na so Paul Biya start. If we no act fast, Tinubu go try become our own Paul Biya,” El-Rufai add. But Bayo Onanuga don clap back, say all those talk wey El-Rufai dey talk no get head. E say El-Rufai and him new party people for African Democratic Congress (ADC) don dey realise say their plan to remove Tinubu for 2027 no go work.

“Former Kaduna State governor Nasir El-Rufai need small help, because all these kain talk wey e dey carry now no get base. Na clear say El-Rufai don begin see say him and him people wey dey follow am for him new party no fit stop President Tinubu from winning 2027 election. Di plan don already fail before e even start,” Onanuga talk. “After di massive welcome wey President Tinubu get for Kaduna last Friday, El-Rufai shock say di North still dey support Tinubu strong. This one no match di story wey e dey try sell say North don dump Tinubu.” “Instead of to accept di truth, e come dey spread another round of fake gist, like say President Tinubu wan turn life president after 2027, that one na story wey no get head or tail, na complete nonsense,” Onanuga add. “President` Tinubu na real democrat, and e no get any plan to remain for office pass May 28, 2031, when e go finish second term after Nigerians re-elect am for 2027.” Onanuga still throw one final jab: “Governor Uba Sani fit try reach out to him former oga, because e be like say El-Rufai need small professional counselling to clear all dis kain hallucinations and political lies about Tinubu and 2027.”

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app