Di management of Dangote Petroleum Refinery don sack all di Nigerian workers wey dey work for dia company. One political commentator, Imran Wakili, share di statement on top X on Wednesday. “Dangote Refinery don officially lay off all e Nigerian workers under di disguise of ‘reorganisation’, just less than 24 hours after 90% of dem join PENGASSAN,” Wakili talk. According to am, di sack happen shortly after majority of di staff, about 90% join Petroleum and Natural Gas Senior Staff Association of Nigeria (PENGASSAN). Inside one memo dated September 25, 2025, wey Chief General Manager of Human Asset Management, Femi Adekunle, sign and Wakili post for X, di company claim say dem sack di workers as part of “total re-organisation” because of reported sabotage for different areas of di refinery. Di memo direct all affected staff make dem return any company property wey dey for dia hand give dia line managers and collect exit clearance.
Finance department don also receive instruction make dem calculate wetin go reach each person based on dia work agreement for proper payment. Management of di refinery still thank di workers wey dem sack for dia service before dem go. Dangote Refinery and PENGASSAN don dey inside serious trade wahala over di issue of union membership.