Listeners:
Top listeners:
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Israel Prime Minister, Benjamin Netanyahu, don deny accused say dem dey do “genocide” for Gaza or dey use “starvation” as weapon. He talk this one on Friday for United Nations General Assembly for New York. Netanyahu talk say instead of starving Palestinians, Israel dey even help feed people for the war-torn Gaza. According to am, “People wey dey carry fake story say Israel dey do genocide no better pass those wey spread lies against Jews during the Middle Ages.” As e dey address the world leaders, Netanyahu talk say Israel don “crush the bulk” of Hamas terror operations, and dem go finish the fight “as fast as possible.” He also brag say Israel don get plenty strategic victories within the last one year, including hitting Iran’s nuclear program and allegedly killing Hezbollah leader, Hassan Nasrallah, for Lebanon.
As Netanyahu enter stage begin talk, many country delegates waka comot from the hall in protest. But at the same time, supporters wey dem invite for the gallery begin clap and cheer am. Na him open the day’s speech for the UN General Assembly on September 26, 2025, and na serious tension mix with applause as he dey talk. Dem even need to call delegates to order as the drama dey happen inside the UN headquarters.
Written by: News Editor 2
GAZA Genocide Denial Netanyahu UN Speech
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025