National

Plateau Police Don Arrest Suspect Wey Dey Supply Food To Kidnappers

todayOctober 3, 2025 7

Background
share close

Plateau State Police Command on Thursday parade 15 suspects wey dem arrest from different parts of di state for crimes like kidnapping, armed robbery, murder and others. One of di main suspects na Auwal Mohammed, wey dem catch as e dey try carry bread and other food items go supply kidnappers for Mazah community inside Jos North LGA. Commissioner of Police, CP Emmanuel Adesina, yarn for press briefing say early investigation show say Auwal dey among kidnap gang wey dey operate between Plateau and Bauchi States. Na detectives from Anti-Kidnapping Unit nab am as e dey go deliver food give im gang. Dem search am and find cutlass, bread, cigarettes, powdered custard, torchlight, glucose, Top Tea, and Tecno Camon phone wey he say na from one of di victims.

Di CP talk say Auwal confess say him be member of kidnapping group and say na supplies e dey go deliver while dem dey wait for victim family response. E still dey for police hand while dem dey track im gang members. Three other suspects, Sunusi Abdullahi, Suleiman Saidu, and Abbas Yusuf, also land for police net for kidnapping work around Mista-Ali area of Bassa LGA. One kidnap victim wey dem call Ebuka was rescued during operation wey lead to di arrest of Joshua Ponzing Nathaniel, Zairuma Sani, Abas Sani and Nanfa Goni wey carry locally made pistol. Others wey dem parade include Inusa Yahaya and Abdulrahman Suleiman wey get local revolver rifle, and Godwin Jacob wey dem catch with local pistol. CP Adesina assure everybody say police dey ready to protect lives and property, especially as we enter “Ember Months” wey crime dey usually high. E say all DPOs and patrol heads don get order to start serious surveillance across Plateau.

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app