Listeners:
Top listeners:
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Di Nigeria Police Force don talk say dem don suspend di enforcement of tinted glass permit for motor dem, sake of court order wey stop di whole exercise. SP Josephine Adeh, wey be di tok-tok pesin for Federal Capital Territory (FCT) Police Command, yarn dis one for AIT on Wednesday, October 8. She confirm say di mata na afta dem receive official court order. “Information wey reach me from PRO office be say di order don land and tinted permit enforcement don dey on hold now till court drop final judgement,” she talk. She still add say di suspension go remain like dat till court finish di legal process. “We dey wait verdict. We no dey against court, and we go still dey wait till we hear di final judgement,” she add.
She kon clear di air on why dem even start di tinted permit mata, say na for security reasons dem introduce am. According to her, some bad guys dey use tinted motor take do criminal runs, wey dey make am hard for police to trace or identify dem. “No be we make di law, we just dey enforce am. Di policy na because of security. Some criminals dey use tinted motor do badness, and e dey hard to identify dem,” she yarn. She also deny say police dey use di policy make money, say all di tinted permit payment na directly into di Federal Government Treasury Single Account (TSA), no be police dey chop di money.
Written by: News Editor 1
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025