Sports

CAF Don Expand WAFCON To 16 Teams

todayNovember 5, 2025 4 1

Background
share close

CAF on expand WAFCON to 16 teams as Morocco set to host 2026 edition. Di Confederation of African Football (CAF) don increase di number of teams for Women’s Africa Cup of Nations (WAFCON) from 12 to 16, according to Completesports.com. Di new format go start from di 2026 edition wey Morocco go host. So far, 12 countries including di defending champions Nigeria don already qualify for di tournament. Dem don join by four other teams wey be di best-ranked according to di current FIFA Women’s World Ranking among those wey lose for di final qualifying round. Di four countries na Cameroon (66th), Côte d’Ivoire (71st), Mali (79th) and Egypt (95th).

CAF talk say di expansion dey show dia bigger plan to strengthen women’s football and promote inclusivity across Africa. Di new format go make competition tougher and also give more countries chance to showcase dia progress for di African football stage. Di 2026 WAFCON finals go run from March 17 to April 3, 2026, and e go also serve as di qualifier for di 2027 FIFA Women’s World Cup.

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app