National

Odumeje Fire Nigerian Pastors, Call Dem Fake

todayNovember 28, 2025 1

Background
share close

Nigerian controversial clergyman Chukwuemeka Cyril Ohanaemere, wey everybody sabi as Odumeje, don fire Nigerian pastors, claim say dem refuse talk against di government. As him dey address him congregation, di prophet yarn say plenty Nigerian pastors dey benefit from di system, na why dem dey keep quiet. According to am: “Bad government dem can never talk about am. Fake people. I no dey move by people; I follow you based on your spiritual attitude. And everybody wey stand for altar for this government, you must talk.”

Odumeje still drag church leaders join, talk say dem get security wey dey protect dem if gbege burst, but dem go still deceive dia followers with olive oil and sticker. He talk say, “Na una dey cause am, giving pastors police and MOPOL to guard dem, but dem go give you olive oil and sticker make you go house. You go trek go house, while him go house with police. One miracle wey you never do for your church, but you dey brag say you be Bishop.”

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app