Nigerian controversial clergyman Chukwuemeka Cyril Ohanaemere, wey everybody sabi as Odumeje, don fire Nigerian pastors, claim say dem refuse talk against di government. As him dey address him congregation, di prophet yarn say plenty Nigerian pastors dey benefit from di system, na why dem dey keep quiet. According to am: “Bad government dem can never talk about am. Fake people. I no dey move by people; I follow you based on your spiritual attitude. And everybody wey stand for altar for this government, you must talk.”
Odumeje still drag church leaders join, talk say dem get security wey dey protect dem if gbege burst, but dem go still deceive dia followers with olive oil and sticker. He talk say, “Na una dey cause am, giving pastors police and MOPOL to guard dem, but dem go give you olive oil and sticker make you go house. You go trek go house, while him go house with police. One miracle wey you never do for your church, but you dey brag say you be Bishop.”