National

FG Go Soon Name People Wey Dey Finance Terrorism

todayDecember 1, 2025 8

Background
share close

Di Special Adviser to President Tinubu on Policy Communication, Daniel Bwala, don drop bombshell say Federal Government go soon expose di big men and networks wey dey pump money into terrorism for inside Nigeria.

Bwala yarn for TV sit don talk say Tinubu administration don dey take heavy, far-reaching security decisions, and Nigerians go soon see clearly who dey sponsor, shield and empower terrorists across di country.

E add say terrorism don turn global market of wahala since 9/11, and na why international partners must join body with Nigeria as extremist operations dey shift enter Sahel and West Africa. Meanwhile, Shettima wey represent Tinubu for di AU–EU Summit, don warn say Africa no go dey hand over conflicts to private military contractors, because dem dey scatter sovereignty and weaken real security efforts wey goment suppose lead.

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app