Di Special Adviser to President Tinubu on Policy Communication, Daniel Bwala, don drop bombshell say Federal Government go soon expose di big men and networks wey dey pump money into terrorism for inside Nigeria.
Bwala yarn for TV sit don talk say Tinubu administration don dey take heavy, far-reaching security decisions, and Nigerians go soon see clearly who dey sponsor, shield and empower terrorists across di country.
E add say terrorism don turn global market of wahala since 9/11, and na why international partners must join body with Nigeria as extremist operations dey shift enter Sahel and West Africa. Meanwhile, Shettima wey represent Tinubu for di AU–EU Summit, don warn say Africa no go dey hand over conflicts to private military contractors, because dem dey scatter sovereignty and weaken real security efforts wey goment suppose lead.