By: Alice Iduh
Speaker of the rivers state house of assembly, Amaewhule Martins don waka comot from PDP join 15 oda members of di House of Assembly on Friday, as di session dey go on.
Dem talk say di wahala inside PDP na why dem gatz japa comot from di party.
Among di big names wey join di waka na Deputy Speaker Dumle Maol, Major Jack, Linda Stewart, Franklin Nwabochi, Azeru Opara, Smart Adoki, Enemi George, Solomon Wami, and di rest wey make 16 total.
Dem don announce di defection public, wey don shake di political scene for di state as people dey watch who go follow who next.