News-auth

1164 Results / Page 1 of 130

Background

obodo oyinbo

Germany Make Moves To End Strait Of Hormuz Blockade

By: Esther Ayoola Senoir man German Chancellor Friedrich Merz like dis dey cut chain oh, say Germany ready to help stop Iran from blocking Strait of Hormuz. Im yarn dis one During im visit to German army for Munster, e say dem fit even use military join secure free movement of ships if need arise. Say any long blockade go cause serious economic wahala for many countries.

todayApril 30, 2026 10

Sports

Mainoo Sign New Man United Deal Till 2031

By: Esther Ayoola Kobbie Mainoo don sign new contract with Manchester United wey go keep am for club till 2031. Di 21-year-old midfielder wey join di academy since 2014 don already play 98 matches, even score di winning goal for 2024 FA Cup final and represent England for Euro 2024 final. Mainoo talk say Manchester United na im home and di club mean everything to im and im family. E […]

todayApril 30, 2026 8

Lagos

Jandor Pull Out For Lagos Governorship Race

Di 2023 Pipos Democratic Party Lagos state governorship candidate, Dr Abdul-Azeez Adediran, AKA Jandor, don withdraw from Lagos 2027 governorship race. He tuk dis one on Thursday for news conference, say e dey follow President Bola Tinubu endorsement of Deputy Governor Obafemi Hamzat as APC consensus candidate. Jandor, wey be Lagos4Lagos Movement leader, explain say dem don earlier agree to support whoever party choose, so he decide to step down. […]

todayApril 30, 2026 10

National

Supreme Court Nullify PDP Ibadan Convention

By: Esther Ayoola Nigeria top court don nullify the national convention wey Pipos Democratic Party hold for Ibadan on November 15 and 16, 2025. Say with dis judgment Tanimu Turaki branch otilor, saying dat di Supreme Court tok say dia appeal no get merit. For di split decision, three justices agree say di group break court order wey Federal High Court give before di convention. Justice Stephen Adah come talk […]

todayApril 30, 2026 9

National

PRP Welcome Ex-LP VP Candidate Baba-Ahmed to Party Fold

By: Esther Ayoola Peoples Redemption Party don officially welcome former Labour Party vice-presidential candidate Hakeem Baba-Ahmed into dia party fold. Di announcement come on Thursday for Abuja, as party National Publicity Secretary Muhammed Ishaq tuk say Baba-Ahmed join na big boost for dia plan to build better and prosperous Naija. According to Ishaq, Baba-Ahmed entry na “new dawn” wey go help strengthen dia push for good governance, better security and […]

todayApril 30, 2026 8

National

Tinubu Promote Odumegwu-Ojukwu, Appoint Enikanolaiye As New Minister

By: Esther Ayoola Bola Tinubu don appoint Bianca Odumegwu-Ojukwu as new Minister of Foreign Affairs, promote am from Minister of State for di same ministry. Di announcement come on Wednesday through statement wey Bayo Onanuga sign for Abuja. According to distatement, di change happen afta Yusuf Tuggar resign from di position to pursue him governorship ambition for 2027 elections. Onanuga sti tuk say President don nominate Sola Enikanolaiye from Kogi […]

todayApril 30, 2026 14

National

FG Declare May 1 Workers Day Public Holiday, Hail Nigerian Workers

By: Esther Ayoola Federal Gornment don declare Friday, May 1, 2026, as public holiday to mark International Workers’ Day. Minister of Interior, Olubunmi Tunji-Ojo, announce di holiday and hail Nigerian workers for dia hard work and contribution to di country. E tuk say workers effort dey very important for Naija growth and better development. Gornment sti encourage dem make dem continue to dey patriotic, work well, and stay committed to […]

todayApril 30, 2026 9

National

IGP Disu Say Make Dem Sack, Charge Police Wey Kpai Civilian for Effurun 

By: Esther Ayoola Di Inspector General of Police, Rilwan Olutunji Disu don order make dem sack and prosecute di police officers wey shoot one civilian for Effurun, Delta State. U sabi di internet dey hot dis week as a uniform olokpa go kpai one man by name, Mene Ogidi For press briefing wey hapun for Abuja on Wednesday, di IGP point finger for ASP Nuhu Usman as di main officer […]

todayApril 30, 2026 14

obodo oyinbo

How US Blockade Put Dey Affect For Iran Oil Business

By: Esther Ayoola Iran Parliament Speaker Ghalibaf tuk say US blockade nor be any issue to dem, and say Iran fit still manage di pressure for about 30 days. US dey insist say di blockade dey affect Iran oil trade, and e fit force dem to store oil reach level wey go slow or stop production. According to reports,  Iran oil storage don rise since April 13, especially for Kharg […]

todayApril 30, 2026 9

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds