By: Alice Iduh
Progessives Congress wahala for Cross River don scatter reach national level as di party National Working Committee don All overturn di move wey State EXCO make to remove dia chairman, Alphonsus Ogar Eba.
National Legal Adviser, Murtala Aliyu, send letter wey summon Eba make e come Abuja on Monday, December 8, to answer di vote of no confidence wey dem pass for am.
Di summons land as majority of SEC members talk say di System no want Eba again and de don announce say dem don comot am, but Eba fire back say di action na illegal joke.