By: Esther Ayoola
Wi oga presido Bola Tinubu like this like this don do two aside tuk with French presido Emmanuel macron about security palava wey don scarra area for inside the obodo 9ja and how dem fit join hands handle am.
The tuk happen on Sunday, as US delegation, including us ambassador to Nigeria, meet national security adviser nuhu ribadu for Abuja to clear the relationship between jaguda boys an christians.
Macron yan for x say France go continue to support nigeria and waka closer with nigerian authorities.
E also talk say France dey stand gidigba with Nigeria to tackle terrorist wahala for the north.