National

Oga Presido Tinubu, Macron Align Marras On Naija Security

todayDecember 8, 2025 11

Background
share close

By: Rilwan Agbomeji

Presido Tinubu and France oga patapata, Emmanuel Macron don reason for phone on Sunday on top di security gbege wey dey shake Naija.

Di phone call happen for di same time when one US delegation and dia big big officials land Abuja go meet Nuhu Ribadu to reason di tori on top Christian persecution and killings.

 Macron later yarn for X say France ready to stand gidigba with Naija and no go slack when e reach to back Tinubu carry fight give jaguda boiz for North.

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app