By: Rilwan Agbomeji
Presido Tinubu and France oga patapata, Emmanuel Macron don reason for phone on Sunday on top di security gbege wey dey shake Naija.
Di phone call happen for di same time when one US delegation and dia big big officials land Abuja go meet Nuhu Ribadu to reason di tori on top Christian persecution and killings.
 Macron later yarn for X say France ready to stand gidigba with Naija and no go slack when e reach to back Tinubu carry fight give jaguda boiz for North.