By: Esther Ayoola
Presidential candidate of Labour Paty and before before Anambra state govo, Peter Obi, don tuk say Naija no suppose dey poor, no be poverty capital of world, because God don bless us with plenty resources wey dey under our foot and wey dey for sky.
E yarn this mata for one book launch for inside Abuja wey dey talk about the ogoni experience and how di people there don dey very very courageous.
Obi emphasis say Niger Delta no suppose negotiate with goment but goment suppose dey thank them for dia idea wey dem get to turn around the country.