National

Army Raise Alarm Over Fake DSSC 29 Recruitment Form

todayDecember 26, 2025 12

Background
share close

By: Rilwan Agbomeji

Nigerian Army, through Acting Director of Army Public Relations Anele Appolonia, talk on Friday for dem official X page  don clear di air say nor be dem post  DSSC 29 recruitment advert wey dey circulate online na fake.

Anele talk say Nigerian Army never announce or approve any Direct Short Service Commission or Short Service Commission recruitment for anywhere for Nigeria at dis time.

Army warn Nigerians make dem no fall victim because scammers dey use di fake advert take deceive pipo and collect money.

She explain say anytime recruitment start, Army go officially announce am through dem website, verified social media pages, newspapers, and oda recognised platforms.

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app