National

Breaking: Rivers Assembly Start Waka To Comot Govnor Fubara From Office

todayJanuary 8, 2026 11

Background
share close

By: Rilwan Agbomeji

Rivers State House of Assembly don start impeachment process against Governor Siminalayi Fubara and im deputy, Ngozi Oduh.

During plenary wey dem show live for Television on Thursday, Speaker Martins Amaewhule preside as Majority Leader, Major Jack, read di allegations of gross misconduct against Fubara.

Twenty-six lawmakers sign the notice, say di mata involve serious wahala against di Nigerian Constitution.

Amaewhule tuk say dem go serve Governor Fubara di notice within di next seven days.

 

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app