National

Kwankwaso: I Go Only Join Party If Dem Give Me Top Slot

todayJanuary 9, 2026 10

Background
share close

By: Esther Ayoola

National leader of di New Nigeria Peoples’ Party (NNPP), Senator Rabiu Musa Kwankwaso, don say e go only join any political party for 2027 election if dem offer am presidential or vice-presidential ticket.

Kwankwaso tuk dis one on Thursday during one Kwankwasiyya gathering wey hold for im residence for Miller Road, Kano, while e dey address ongoing political realignments ahead of di next general elections.

E explain say di party wey e go align with must give am di top slot for national election, to secure proper political footing.

Di statement come as speculation dey spread say Kano State Governor Abba Kabir Yusuf fit leave NNPP join All Progressives Congress (APC).

Written by: News Author

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app