By: Esther Ayoola
Oyo State Govo, Seyi Makinde don clear di air wetin make am buy waka enter Aso rock, say e nor get any plan to leave Pipos Democratic Parti.
E tuk dis one afta e go see President Bola Tinubu for Aso Rock on Thursday.
When tori pipo block am for gate, as e dey come out from Aso rock, con ask am if e wan join di All Progressives Congress, like some of im former PDP people, Makinde make am clear say, im dey okay and comfortable for PDP.