Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
By: Esther Ayoola
Pipos Democratic Parti, Africa Democratic Congress and Labour Party, say, like dis, dey squeeze wetin nor good for dia face dat All Progressives Congress don finish Nigeria following di defection of Kano State Govo, Abba Yusuf.
Di opposition parties tuk say di Kano state Govo move dey smell, and dat na moral failure, and norbi real politics be dat.
Untop yarning with tori pipo on Sunday, Labour Party faction chairmo, Senator Nenadi Usman, warn, say make pipo nor dey confuse big men defection with support from ordinary Nigerians, adding say opposition sti strong for coming elections.
But APC publicity director, Bala Ibrahim, welcome Abba Yusuf happily, say im move na big boost and proof say APC dey deliver beta governance to Nigerians.
Written by: News Author
APC crisis Kano governor Party defection Nigeria
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025