Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
By: Esther Ayoola
Na beta gbege ni burst between House of Representatives and Minority Caucus over committee wey dem create to investigate changes for di Nigeria tax laws.
Chairmo of di Minority Caucus committee, Afam Ogene, warn say if dem dismiss di interim report, e go ginger anyhow doings and weaken National Assembly.
House deputy tuk, tuk, Philip Agbese, dey complain say, wetin dem dey report, say other event don over take am, afta some Certified True Copies of di tax laws enter public.
Ogene respond dat, Agbese na principal officer, e suppose protect integrity of legislature and democratic process, say whether e reach public or not, everytin wey nor correct inside di tax law dem suppose torchlight and correct.
Written by: News Author
House of Representatives Minority Caucus National Assembly crisis Tax law report
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025