By: Esther Ayoola
Wi oga Presido, Bola Ahmed Tinubu in honour of late Chief Samuel Akintola, don drop advice for Nigerians, to always dey courageous, and avoid bitterness and division.
Baba Seyi deliver dis message through di Secretary to di Government of di Federation (SGF), Senator George Akume, wey go represent am, for di 2026 Samuel Akintola Memorial Lecture wey shelle for University of Ibadan.
Tinubu tuk for di lecture wey dem title “Unity in Diversity: Lessons from Chief Ladoke Akintola’s Legacy” say, na proper way to honor one of Nigeria big nationalist leaders.
E also remember how Akintola and other leaders lose dia life for January 15, 1966 coup, and dat Nigeria don survive di lose of di great mehn and go continue to stand as one strong country.