By: Esther Ayoola
Oga Chairmo of Presidential Committee on Fiscal Policy and Tax Reforms, Taiwo Oyedele don declare say di new tax law need employers and individuals to submit dia tax returns by demselves, dat employers submit reports b4 March 31 every year.
Oga tax dey tuk dis one for one online tuk wey dem organize for HR managers, CFOs, payroll and tax officers, dat, many Nigerians never dey file dia self-assessment returns.
E clarify say di “power of substitution”, dat is gorment going to pipo account to debit dem, wey plenti pipo dey fear nor dey new, e dey normal for tax law.
Oyedele warn say everybody suppose to obey di law and make sure dem file dia tax returns.