National

APC, NNPP Question U.S. Over Visa Ban Wey Dem Wan Put For Kwankwaso

todayFebruary 12, 2026 2

Background
share close

By: Rilwan Agbomeji

All Progressives Congress (APC) and New Nigeria Peoples Party (NNPP) don reject di proposed visa ban and asset freeze wey some US lawmakers wan place on former Kano governor, Senator Rabiu Kwankwaso, plus Miyetti Allah groups over alleged religious freedom violations.

Di bill wey dem call “Nigeria Religious Freedom and Accountability Act of 2026” na Rep Chris Smith and some oda US lawmakers sponsor am, and dem say na to punish people wey dem accuse of abusing religious freedom.

APC talk say mere allegation no suppose be enough to stop Kwankwaso from travelling without fair hearing and due process.

NNPP too back Kwankwaso, say di proposed sanctions no fair and e get political undertone.

 

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app