By: Esther Ayoola
Vice President Kashim Shettima go lead one Federal Gornment team go Kano afta fire burn Singa Market last weekend.
Say, Di team dey go show di President sympathy to traders wey lose billions of naira for di fire.
Among di team na Naija House Speaker, Tajudeen Abbas, Deputy Senate Presido, Barau Jibrin, Kawu Ismaila, and Abubakar Kabir Bichi wey be Chairman of House Committee on Appropriations.