By: Esther Ayoola
First Lady of di federal republic of Naija, Oluremi Tinubu, don hail doings of Naija hospital say dem registration of 14 million new born babies
She yarn dis mata on Monday via her X handle afta she receive UNICEF Country Representative Wafaa Abdelatef and her team wey brief her on birth registration progress last Friday.
Senator oluremi describe di movement as major achievement to protect pikins identity for di obodo Naija.