By: Esther Ayoola
Former Kaduna State Governor, Nasir El-Rufai, don drag Independent Corrupt Practices Commission, ICPC, go court for ₦1 billion, say dem enter him Abuja house without permission.
Im lawyer, Oluwole Iyamu, SAN, clear tori pipo for Abuja say di search warrant wey Chief Magistrate for FCT issue on February 4 nor follow at all.
For di suit wey dem file on February 20, El-Rufai name ICPC, di Magistrate, I-G of Police, and AGF as respondents, say all of dem get question to answer.
El-Rufai dey ask Abuja court make dem declare say di search warrant wey dem use enter im house na null and void and make dem pay 1 billion naira as fine.