By; Esther Ayoola
Police for Ondo State don arrest 10 suspected kidnappers for Akure and recover ransom money wey dem collect from dia victims.
Police tuk, tuk, Jimoh Abayomi, konfamate to tori pipo, from force headquarters, say di arrest na big breakthrough as dem dey continue crackdown on kidnapping and other violent crimes for di state.
Say na joint operation between Anti-Kidnapping Section and PMF personnel from Force Headquarters carry out di arrest afta dem get solid intelligence along Ondo Road.
Di Police recover one operational motorcycle and some burnt ransom cash, and dem say investigation still dey go on to catch other members of di gang wey escape.